Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: My country is a funny place.
by
dewilliams
on 17/04/2023, 19:07:36 UTC
Nor be lie you talk..with wetin dey happen for the country e just show how corrupt the citizens are. The scarcity of the cash wey still dey on show say most Nigerians nor be good people because I nor understand how you go charge 4k for 10k withdrawal. Also, even the just concluded elections show say na only our belle wey matter to most of us. As long as we dey benefit from the evil, other people fit go to hell. Walihi e dey pain me reach my heart. We just need a general value reorientation for this country I swear.
We thank God say this cash less policy don dey small small come to an end,finally money don dey dey. The charge wey been dey very high don already come down to normal,1k now don be hundred naira charge for my area, except some people wey wan thief nai still dey make their charge too much.Most of the banks wey no been gree give out cash don dey dispense cash now,and last last people business don dey go back to normal.Election don end,we don see who dey lead us now,but the only prayer wey Nigerian citizens just gat pray be say,make the person wey wan lead us now better be good person,person wey no go thief Nigerian people money.I know say dem Neva swearam in,but we just dey hope say him go do well,because the past government been no try at all.
Make this new presidoo just try provide job for youths because job wey no dey the country don almost turn all the youths into streets,( yahoo) and we no go fit blame dem because work no dey.
  we thank God oo my brother  for the cash less policy when don they come back to normal everything don they end small small and we Nigerians make we pray well well oo make God torch the heart of our government make him no carry  our money run and make him make things change for everybody  good oo and provide job opportunities for our youth to end these street (yahoo)and we no go fit blame them because na food for their belle they dey find