My advice be say way person nor dey trust all this Naija crypto company becos this thing nor easy for them bcos of CBN.
Dem really talk say
nah who know man dey kill man.
See for this industry if everybody get this kind mindset then how you think say naija go take grow for this crypto space? Abi you except those foreigners to use watin we naija nor gree use ourself?
Yes, yes, I know say our yahoo-yahoo boys don dey make us doubt everything when dey for naija but if we not believe in our self how we go expect others to believe in us? So if you see better industry for naija when dey sure say he really legit make we dey try support by using it, majorly we naija nah users we be for the crypto space and if the togetherness really dey we go move from users to creators one day.