Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Woman sells her child to repay loan
by
NdaMk
on 19/04/2023, 20:13:13 UTC
That one no be excuse for she to go sell her pikin, wetin she use the 600k loan wey she collect do, this matter funny shall, to me sef I fit even say that woman no get conscience at all, or you even sure say na she born that baby wey she want sell to use repay loan?
E really baffle me say a mother go carry pikin for belle for nine months, born am finish, come go sell am all because she want repay loan of 600k omoh this story no clear at all to me, make Dem ask her well who get that pikin...
You think say the way some people Dey treat pikin this days you no go know say na born wey he Dey to born dem born them. Some of them self Dey throwaway am after giving birth. I hope say government officials don catch her and even the buyer because both of them na threat to our community.

As for women on top borrowing me I no know when they go stop that one. The worst thing be say most of them na on top extravagances dem they spend am