Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The Latest Ponzi Scheme in Town, pls Avoid it.
by
DaNNy001
on 27/04/2023, 12:14:21 UTC
Mate thank you very much for this information. These scammers are bringing new new Ponzi schemes to scam people in di country. Only the registration process will make you to know that it is fake. How can some registered a business platform with only a phone number and password ? This is what they did in stepwork forward which people lost plenty money before last year.
Ponzi scheme no fit ever stop for dis our country, everybody de look for easy and fast wey to make money na y if de see Ponzi scheme, dem de believe say na legit and easy way to make sharp money, some of them know say na Ponzi scheme but de go wan enter make sharp money before e go cast. Plenty people don fall for Ponzi scheme hand but de no go still hear word, if de still see new one de go do am.
My broda no be for only this country wey ponzi scheme and scammers dey operate e go even shock una say the Philippines and India na countri wey dem too dey strong for all this scammers related issues as the world dey advance everyday na so new method to take scam people around the world dey come every day. So every one should just be on the alert and notification to all these scammers.