This matter just tire me so I say make I post am.. The way police dey worry youth for road whether you get car or not as long as say you be guy..Them don assume say you dey do yahoo.. Person no go fit drive car or use expensive things again for this country..
Abeg make una help join mouth for this matter...
Most of the cases of police brutality na against the youths and wetin dey cause am most na the way dem dey dress for street. Here no be oyibo land wey you go wear rag and nobody go send you. We get our culture and na dat our culture mindset na him police for our country dey use still discipline the youths. I no dey try justify the brutality against youths for our country but sometimes we suppose know how we go dey dress comot for public, because the way we dress naso dem go address us.
I know of some people wey get money and still dem no dey harass dem but rather respect dem because of the way dem dey dress for society. To the police and we the masses, we all have dis mindset say person wey dey do yahoo dey always dress anyhow and dey made it look so because that’s what dey always do and dis has affects even those that knows nothing about that. If we no wan make dem take us the same, make we know how we go dress and look for public because those men no get joy, before you go explain yourself finish you for don chop beating finish by then. So make we dey careful always and pray all this harassment ends soon.