My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
This na bad omen o. Sometimes we go dey reason am say maybe na kidnapping sup like dis but sometimes e dey far from it. With the rate at which everybody wan make am for dis life now, ritual don become normal thing too oo. I pray dem no dey missing for any of those purposes but make our parents no dey allow children dey move out anyhow all in the name of party especially for night because this country no safe again. I pray dey find them and they return home safely, if not dis matter no funny again oo.
Abeg read the forum rules well no be when them catch you for copy and paste you go come post topic for local board.
Lol, maybe OP just dey come here dey chill and disguise after him don collect warning for general board. @Ledway better listen to advise make you no go chop ban o.