This matter just tire me so I say make I post am.. The way police dey worry youth for road whether you get car or not as long as say you be guy..Them don assume say you dey do yahoo.. Person no go fit drive car or use expensive things again for this country..
Abeg make una help join mouth for this matter...
E dey worry we the youth say we no fit waka, sleep or dey do we daily tinz with peace of mind for this country without police or efcc dey raid us. Few days ago around 2am, dem raid one compound wey student dey for my area. Dem beat some people wey dey inside and carry dem go put for their van after dem search their phone come see only BINANCE and TRUSTWALLET Apps for their phone. Dem talk say dem be yahoo boys but dem boys provide evidence say dem be forex and crypto traders. Dem come still collect #300k from dem even though dem no see anything for their phone, just dey beat dem to confess crime wey dem no do.
E be sad💔.