My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
D rate at which young guys dey look for money now don too much, dey are ready to do everything possible just to make this money, and girls also, their eye no dey stay one place, na guys wey go spoil them with money dem dey look for, some of them know say Wetin d guy wey dem dey follow dey do no pure, but dey go still dey follow the guy just because of the money wey dem dey get from the guy. For my side if you hear say girl lost mostly na boyfriend side she go, most of them na all this yahoo boys dem dey follow and at the end, those guy go just end up using them. If girls fit dey satisfied with Wetin their parents they give dem and make dem they do legit hustling, make dem no dey depend on boyfriend, then am sure d way girls dey lost go reduce.