Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How would you invest N100,000?
by
CryptopreneurBrainboss
on 08/05/2023, 22:30:34 UTC
If you have N100,000 how would you invest it? Here is what someone recommended based on their own experiences, knowledge etc. They broke it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments. Continue reading . After reading it, I'd like to read your recommendations too.

How would you invest N100,000? Break it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments.

Who dey say #100k too small, I hope say una know say minimum wage for the country na #30k and we get people wey no fit saved out #100k at the end of the year if not for other side hustle wey dem fit dey do. I dey see say crypto dun spoil una to the extend una no dey value Nigeria money again. If #100k too small carry am enter street and dash 10 people #10k then watch the joy wey go dey dem faces when they received that money wey be just 10% of wetin una dey talk say too small.

If na only #100k I get to invest, and I need divide am into 3 ways as you talk see as I go do am. 50% go into crypto investment wey I go consider high risk and I no go buy Bitcoin. I go closed eye put am for any of those these two altcoins wey I know say my money no fit loss anyhow like BNB or Ethereum. The target go be to get like 10x for this coins or atleast 5x go possible before next bull market finish wey go make that 50k either 250k or 500k.

Then I go put 30% for the low risk business wey go be buying of banks shares, I go just run 30k dat side as I know that money fit increase give me small profits ontop or e stay like dat and I fit withdraw am hold body Incase my other investment fall my hands and lastly I use the last 20% wey be 20k use do palmpay business wey be lending. I see lending as a medium risk business as I must collect collateral before I lend out the money. I no put Bitcoin for this matter as I go dey manage the Bitcoin I dey gather from my activities for the forum.