Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread.
by
Mpamaegbu
on 09/05/2023, 07:31:14 UTC
My Username na ‘Framelover’, I be guy man wey get interest for crypto. I wan learn more about Bitcoin and other digital money dem. I lyk to trade, invest n I wan explore d potential of blockchain technology. I get Joy say I fit to connect with una and learn from una.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.
Framelover and Kelward, we take open hands welcome una two for owa midst. I like as una talk sey una dey ready to learn because na dat wan be d koko wey make everyone of us enta here and then we com realize sey honey dey here too. Betta honey oh. Make una go thru d rules and keep dem. Nor plagiarism other people articles or spam for forum. If you nor keep all these, see you see ban but if you keep dem, see you see Shiloh as one of owa ogbenge members go yarn.

Oya, una welcome, wey bread 🤗