The thing move me to intervene for the matter before them drive off, but who I be, dem go end up arresting me join the guy, îîand if I no get person wey go bring money to bail me, my name go be sorry. Na fear make me no record them, because them dey see me, assuming say I record, them go intimidate me, collect my phone to hide evidence and arrest me
I don see am happen well well. We need serious police reform for this Nigeria.
The harassment don too much now for Naija. E come be like sey those police officers don forget wetin happen during endsars. The next time wey dis thing go happen e fit to worse pass endsars wan wey happen for 2020 because frustration and hunger don wet ground now. Anoda thing be sey e good as you nor begin record those police guy brutalizing that young man as dem don see you already otherwise na to seize your phone and assault you remain. Una see as Seun Kuti take deal with dat police guy yesterday and how Nigerians rally support for the poor police guy. Tomorrow now, na the same police guy go assault civilians.