Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of Mental Health Awareness in Nigeria.
by
Framelover
on 17/05/2023, 12:34:49 UTC
Make we try look into this mathias cuz mental health dey really underrated for we country nd na something wey we need to serious about cuz from there, even d change and betterment of d country wey we de talk about go begin workout.
Abeg how Una take reason this mathias?
I make sentence abi I de cap vatica?
Una reason with me say this awareness go actually fit go a long way in helping we country?

Oboy forget am, swallow am, na man you be, all this words na wetin dey kill most of the men for this country. This mental health issue na men dey suffer am pass for this country (I no care if statistics talk another thing). If you know how many man dey die in silence you go shout. Abeg make una dey try treat people right for anywhere una find otherselfs because people dey actually go through alot and I dey encourage everybody here to try talk to person if you notice say your own dum dey do you somehow. No dey shame, na talk dem go talk and e dun finish. If you allow shame kill you na ur own cup of tea be dat. Make we dey open up to one another.

My senior brozzay, me make waw for u wey u help me chuck mouth for dis Mathias.. d mata don too over me na im make I say make I air am. Dis mata don affect me but I don de heal small small and I de don de recover small small. On God we go all de alright nd as u talk am, make anybody wey de suffer from dis tin try seek help cuz na very serious mata wey ppl de underrate.