Make we try look into this mathias cuz mental health dey really underrated for we country nd na something wey we need to serious about cuz from there, even d change and betterment of d country wey we de talk about go begin workout.
Abeg how Una take reason this mathias?
I make sentence abi I de cap vatica?
Una reason with me say this awareness go actually fit go a long way in helping we country?
Oboy forget am, swallow am, na man you be, all this words na wetin dey kill most of the men for this country. This mental health issue na men dey suffer am pass for this country (I no care if statistics talk another thing). If you know how many man dey die in silence you go shout. Abeg make una dey try treat people right for anywhere una find otherselfs because people dey actually go through alot and I dey encourage everybody here to try talk to person if you notice say your own dum dey do you somehow. No dey shame, na talk dem go talk and e dun finish. If you allow shame kill you na ur own cup of tea be dat. Make we dey open up to one another.
If your own shame too much then go see doctor. Him fit help you tell you one or twos wey you fit dey use or do to help your mental health. Also try dey exercise and dey chop well. All this time go help you. No be only outside wahala dey cause mental issue. Both your own overthinking dey causes am therefore to eradicate this thing from the country or to reduce am well well to the bare minimum, den we need to put hands together to educate people to dey talk their mind when their own no good so people fit reason them wetin dem go do to reduced the loan wey dem dey carry for head.
As good as e be for person to yarn with other men them or brothers wey suppose understand, the truth be say no body really care about the issues wey dey bother man or put am for the kind mental condition wey em dey face.
Sometimes sef, the person wey you think say you dey talk to in order to relief your mental state, fit even be the cause or follow contribute to the issue.
E always dey good to dey kind sha, because no be clear eye some people dey use wake up comot for house in the morning o.
Nigerian government suppose get better health care strictly for people wey get so much wey dey bother them for mind. Most times na just to talk dey wan talk. Before the how to solve their problem go come.