Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of Mental Health Awareness in Nigeria.
by
RockBell
on 19/05/2023, 21:02:07 UTC
I greet Una my seniors and fellow beginners. Make una no vex if this topic no sweet una for body but na as e de do me na im make I see am as a concern nd necessity to address am. Cuz even me wey write this article, my mental health de f**kd up.
Mental Health na mathias wey we as Nigerians de overlook, we no de really care about am or take am seriously. This mathias na watyn fit affect person, family, society at large. Many pipu de struggle in silence base on fear say other pipu go use one kain Irene 👀 take kpor dem.
The major reason why be say mental health awareness dey essential be say e de help to remove stigma wey concern mental health issues and e de help encourage pipu make dem for seek help. This mathias fit go long way in reducing mental health disorders nd make e improve our overall mental health for we country cuz una go agree with me so majority of us no too normal (make we tell ourselves truth).
This awareness fit help improve we country productivity nd our quality of life. By dey promote awareness about mental health nd dey encourage pipu make dem seek help wen dem need am, we fit help reduce all these negative effects nd we fit make d overall health nd well being of Nigerians better.
Make we try look into this mathias cuz mental health dey really underrated for we country nd na something wey we need to serious about cuz from there, even d change and betterment of d country wey we de talk about go begin workout.
Abeg how Una take reason this mathias?
I make sentence abi I de cap vatica?
Una reason with me say this awareness go actually fit go a long way in helping we country?


In spite of the fact that many of us have neglected our mental health and that many people, particularly in this country, are struggling, no one is paying attention to it. However, since the majority of what you do is influenced by your mental state, we Nigerians don't view seeing a therapist as being particularly important. However, I think it is crucial that we encourage individuals to seek counseling and communicate to others about their feelings. When we express how we feel, it should help us feel better in some way as opposed to holding it in and having it consume us. Challenges is just driving everyone crazy.