Well no doubt say every body go glady support this notion because the matter don tire everyone and if we only complain amongst our self here e be like say the thing no go work,
I no support the motion and no be say the talk no make sense but at this point it's not needed. How many months is our board? When last you think say theymos grant local board for people and now now you wan go dey request for subboard? The board wey dem give us we never enjoy am we wan go dey create topic say make dem give us more things when others own never dey granted self (na this kind things dey cause envy). Abi una never noticed say Nigerian has been the target and in the radar of recent for defaulters in the forum (from plagiarism to alts wey dey promote rubbish campaigns dem), make things cool down first.
How many Bitcoin related topic wey una dun start before una begin the complain say people dey talk rubbish, why una dey engage in the rubbish in the first place, if una ignore the topic e go go down sharp sharp and when the OP see say people no dey interested him no go create similar topics in the future. We need to develop the habit of creating Bitcoin contents if we want to ask for other subboard to be created. Wetin be the argument wey we wan go gi present give theymos now say we need subboard for this boards wey you no fit count reach three active Bitcoin discussion for the main board?.
Well said! Even though I agree with OP say most of the topics way full here no really follow but as long as them dey get engagement the topics go continue to dey come. The problem na something we go fit manage if we all take am upon ourselves say we no go dey respond to “shit post” but because of post quota we no go gree so make we manage am the way we see am. If them give us this sub board now, how many topics you feel say go fit come up for bitcoin discussion?