Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Off Topic child board.
by
CryptopreneurBrainboss
on 24/05/2023, 15:46:32 UTC
Snr man CryptopreneurBrainboss, I no support you for this  one. If we ask for childboard, no be favour we dey ask for,  e no get anything to do with eyes dey naija. Asking for childboard no be asking for local board.
The message format dey simple.

Sub board matter no be PM matter, subboard only gets approved when other topics are dominating the board wey you wan separate the subboard topics from. To get subboard you need request am as you result other your local board for PM. E get reason why Naira was granted local board ahead of other people wey request first and wey even dey active pass us. Na our coordinations, na be rushing something and besides there are other important things we have at hand wey important pass subboard. First we need to reduces the spam on the board and no be to push them go one side because if we do like that we just spoil the whole local board as Nigerian will be known to be a local board of spammers and low quality users.

That one no be the kind identify we want get for ourselves. Make the post dey happen here for now where we fit dey correct people because immediately we divide the board, some people no go even visit those other subboard and dem go just turn to those altcoins boards wey spam full am like water. For the moment make we they correct the defaulters as dem dey come and make we join hand create more Bitcoin discussions on the main board. When we get more Bitcoin discussion and people see how the contributions dey go dem go join too to dey create Bitcoin discussion. Other discussion can be in sub-threads just as we did the gubernatorial election thread.