Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Off Topic child board.
by
CryptSafe
on 02/06/2023, 07:28:39 UTC
Off-topic child board no go solve the issue of spam for this local board, child board fit even make am worse because some of our Nigerian users fit leave main board go base for off-topic child board they post as they like, you know say many people they erroneously see off-topic boards as a place for spam. E get some threads wey i dey see for our board wey dey too unnecessary, and e make me conclude say some people no sabi use online forum, because e get some matter wey person no suppose carry enter here. Make we leave am as e dey now, na local moderator for sure pass, if spam posts are deleted quickly, e sure me say people go stop to they make spam posts.
exactly and the only thing im fit do be say, im go separate the shitpost thread from the bitcoin discussion topicz. It will not be like dis again where dem dey compiled everything in won place. And it is even better if dem go post for off topic and leaving di main board. All di 2 nai good to get. Both di moderator and boards so everything go dey nice and well arrange.
This one go make sense because for we to get moderator, e go make our local board dey coordinated and organized and e go make our brodas and sistas for here dey do well here. I know say once we get moderator, shitpost and spam go reduce well that one go make everybody for our local board dey up and doing to avoid unnecessary spamming or otherwise.
I just think say the moderator application go dey better for now compared to the childboard because if we get moderator now the board go clean and e go make members measure up to dey do the right thing and shitposting go reduce.