Nigerian government can be successful with the new taxation law by having crypto platforms that are registered and operating in the country like Remitano, Luno, Roqqu, Bitmama, NairaEx etc. pay for their taxes but...Is this tax also applied to individuals using or trading cryptocurrency in these platforms? If yes... Do you think they will have any luck in taxing individuals using this platforms since we've not really had good results in collecting taxes from physical businesses? Also, most of these crypto merchants charges high transaction fees already and with the new law in place, can these platforms include a tax fee for every transactions without most users noticing?
E easy to achieved na, first dem go demand everybody wey dey use the platform to complete KYC and the crypto platform go register under SEC. Belike self na why SEC dun give Binance Nigeria strike one to do fast come register under the SEC. Dem go fit tax us by making sure these platforms collect tax immediately we dey do withdrawal form the exchange. E just belike when you go chop for all this fancy restaurant them, usually if you look your bill wey you get, you go see the tax wey dem dey collect and e dey go government (nobi there pocket). Dem no go tell you about the extra tax until you dun chop finish although e no dey too cost.
The crypto platforms go just send alert to all their customers to inform them about the new laws and since e go dey everywhere we no go get choice but to just use the platforms like that and they pay the tax (but make we no fear as I believe e go be very small amount them). If be small percentage self for each withdrawal so poor man dey saved, na the rich dem go dey milk although e no go mean much to them too but I doubt we'll be able to reach this stages as e go mean Nigerian dun dey accept cryptocurency small small. All this one fit be talk talk matter, you know e no dey hard us as our government sabi talk more than dey do things.