Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Subsidy removal and all you need to know
by
Gozie51
on 12/06/2023, 13:09:28 UTC

why selling old fuel with new price?
Normally na so business be. If you hear about the increment of price for market you no need to allow your former product finish before you increase your price too. Why is it like that? If you no increase the price and you wan wait for your former product to finish that means you no go see new product buy again since the price don increase for market and your money no go reach again.


This na lie. Na because the government dey inefficient and ineffective to monitor wetin people wey dey sell petrol dey do and in fact wetin business people dey do with products wey dem buy. Na masses just dey carry or the load through increment. Government suppose dey control price through the necessary board but na who go do am when dem dey corrupt.

Before I come to petrol own, shebi we know say some people wey dey sell some things like food stuffs, beverages etc, there products dey spoil for there hand if them no sell am quick and in this instance, dem go reduce the price so dat dem fit sell am out quicker, so na who dey pay dem back the difference when dem go buy new one?

Another thing be say if companies dey bring new products for market against the existing old one, customers dey rush the new one and that one most times make the seller to keep the price of the old and new differently.

Now for petrol as marketers dey rush change to new price because make dem for fit buy for new price when dem make order, that na lie. On a normal, new price is suppose to be bought with new price and sold in new price. If dem increase price, you buy based on the new price and sell so as well. Anyway, the regulation for petrol market and control really need some touch for things to make sense.