So like dis now Fg don ban Binance way we sti de manage for crypto exchanges chia
Guys what is the next move to make oo
Because abandoning crypto no b option o
Government no fit ban binance jare, the only thing Wey government dey look for na tax, they want make binance come make dem reason things so that binance go fit dey pay tax, if binance don gree, then case don settle be that. Also even if government ban binance, we go still dey use binance, if we wan buy bitcoin na to dey use our normal p2p now, and other reputable exchanges dey now like KuCoin and their p2p dey okay also, if I no wan use binance I dey always use KuCoin.
The only place wey problem go dey be say if police stop you and search your phone, if dem see anything like binance or crypto na wahala be that ooo, dem go talk say you dey use wetin government don ban for country, you go dey need settle them be that.