Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: President Tinubu, shakes the entire security sector.
by
CryptopreneurBrainboss
on 20/06/2023, 15:04:59 UTC
President Bola Tinubu shakes the entire security sector, as he retires all service chiefs.

Omo presido, don ask for immediate replacement of this security chiefs, BABA just dey touch all the sectors way dey important small small, him don first remove CBN GOVERNOR, EFCC BOSS, now na all the security chiefs.
My people, how Una see dis matter.

Tinubu dey play senior man politics, when dem talk say this man na political father jagaban I think say na lie but na now I dey see am. Him wan put all him loyalist for the positions dem so nobody fot mumu where him dey. As him dey put him loyalist dem, I just hope say dem go work oh even though dem wan share the money because if dem no work na big fuvk up be dat. Another thing wey for justify this him recent actions na say, none of the service chief dey work because we still dey get insecurities everywhere so him dey right to removed them. Na so so incompetent people bee fully this offices. Make tinubu no go put mumu loyalist sha, make dem be people wey go make this governments to sweet.

Tinubu no come play for this office oh, I no go surprised if the man hold the country hostage even when him comfort seat as him just hold Lagos state for pocket wey be say na him dey deliver other successors coming after him. Sha me self no go reason am if the people him dey put dey show working and the country dey go ahead ahead. Like play like play, we go just dey one day hear say dem dun dey comot chief judges and other higher judges for the country. Na that time our eye go clear say this man no wan here say him get problem for this office wey him dey so.