Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Limit on domiciliary account removed, Naira cards restriction should be the next
by
CryptopreneurBrainboss
on 20/06/2023, 15:20:06 UTC
I was greeted with one of the most relieving news of the year today "The limit on the domiciliary account has been lifted." No doubt that cryptocurrency has helped in place of a domiciliary account for cross-border payments, but certainly not in the area of savings in the USD with confidence, that's at least for me as the security of my money is important.

This one na very positive news wey land like this, but me no go advise make we save for dollars at this times, Main reason to saved for dollars na say Naira go weak more but you think with all tinubu is doing and Dangote refinery say Naira go weak more? Dem dun open border already and so many other development wey make sense dey happen. I know say the effect won't be felt immediately as e go take some time. Instead of saving for dollar, ruin am for Bitcoin and I no dey talk this one because say we dey this forum. The benefits plenty. Bitcoin na one coin wey be say no matter how bad the market bad reach, when the time for bull season, na him go lead the market and na better profits you go dey get so.

As for the matter of Naira restrictions abeg make dem no comot am but can increase the limit for daily transaction on our apps dem but make dem no release more naira into circulation abeg. We dun already dey adjust to this one make e stay like that. Too much Naira go commot value for the currency. You no see as dollars been dey cost for the country as e no dey easily accessible. Make dem make naira scare like dat small even though e no reach to the range wey dollars been scares reach. Banks app dey to use so why we need physical cash. If na for the rural areas wey be say our parents dey and dem no sabi operate this apps dem, make we dey send them cash and we dey make use of the apps.