Weti dey happen for here na? Me I no dey understand the whole thing again. Even signature Campaign thread sef now na to translate? When do thing was in one thread, the thing was nicer than like this. Di first time when I see am I even think say Unijoin campaign e don come to do local board for us to participate so when I enta inside I come dey see sae na for translation purpose. By di way, Op u try 4 di work.
For your mind like this I no get wetin I go use my time do abi? 😊 I dey surprise say u dey yan like this because I don see your comments for de ANN thread, so I take am say you too suppose don see am. You no see de post wey dem ask for forum members to help translate the ANN and post for their local boards? Icopress also posted about the translation on de signature thread. Also, look de ANN and you go see links to translations in other languages by members. So I no just do am because I no get anything to do or because I want spam de board.