In an effort to enhance the accuracy and depth of customer identification, the CBN has made it mandatory for financial institutions to collect and verify customers’ social media handles as part of their Know Your Customer (KYC) requirements.
As me self here dis news I just laff, we no really serious for this country. So how dem go take verify say I dey give them my correct social media handle like dis. We no dey coordinate for this country instead of us to hide our head na so we go just dey show our yansh to the world. Shey dem no see all the other verification information wey we dun no get any benefits self now dem why do social media. Anybody wey bring about this suggestions get alternative motive because I remember when End Sars been dey hot, the government to kill people moral begin target big influencers wey dey support the protest and ban their accounts to avoid mobilizing protesters before them shift to running everything with Bitcoin and na where Nigeria government problem with the industry begin dey heat up.
I think say Tinubu just sign data protection bills abi dat one no dey work yet. We supposed get right not to give our this datas dem. E no even dey any necessary and even though dem make am compulsory say we must do am, e no go get any head. Make the banks manage the KYC wey dem already get wth all our vital informations like address, nin, bvn sim registration and so on. Make dem manage dat one because as I talk, na our fundamental human rights dem wan mess with like dis, so dem dey find wey to silent everybody make nobody talk bad about the government because when you do dem fit track you to ur account go mess with your funds and you go come close mouth.