I been here am for news say, the head lines been follow say this two people wan seat do meeting, but apart form that talk, you think say no be Dangote be the major problem of Nigeria food issues because from my own point of view dem no suppose da go meeting with man, if I go ask which kain discussion dem wan do with dat business manny that is serving his own interest.
But mak we caring chair seat think this matter well since dat time wey Obasanjo sell dis country giv Dangote na since then everything com tak change, price of consumable goods nor gree com down again
This matter just get as e be self
Dangote dey among the major problems wey we get for dis country, na why the man no get political party be that now, any party wey win na him d man dey support and all na for him own selfish interest, anybody wey win president for dis country him dey always go do meeting with dem. Dangote do meeting with buhari make dem lock border, dem lock border dangote start to dey produce almost everything wey we dey use for dis country come put money anyhow, see d way prices of things go up for dis country, see d amount wey dangote dey sell cement now. I just pray make him plan no work with tinubu, because dangote dey among people wey dey cause problem for Nigeria, him dey among people wey no allow foodstuffs come down for dis country.