I been here am for news say, the head lines been follow say this two people wan seat do meeting, but apart form that talk, you think say no be Dangote be the major problem of Nigeria food issues because from my own point of view dem no suppose da go meeting with man, if I go ask which kain discussion dem wan do with dat business manny that is serving his own interest.
But mak we caring chair seat think this matter well since dat time wey Obasanjo sell dis country giv Dangote na since then everything com tak change, price of consumable goods nor gree com down again
This matter just get as e be self
Base on my own view about this matter, I go talk say no be Dangote be the problem we get for this country oh, but na our politicians wey dey give am that sole monopoly of taking over the most vital sectors be the problem wey we need to address, because as a business man wey he be, he go always want go over profits then the well-being of Nigerian citizens, which is what our politicians would have done, but yet most of them dey use Dangote as a medium whenever they want launder huge sum of money make EFCC no fit catch them, of which he uses that money to invest and make more profits.
However, I been dey think say since they don launch Dangote refinery say the price of fuel go go down, but na that time eh be like say eh dey rise more.. Abeg wetin dey sub nah. For my side now per litre na #600