Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Dangote and Bill Gates wan close door meeting with the new president
by
CryptopreneurBrainboss
on 28/06/2023, 21:01:01 UTC
I been here am for news say, the head lines been follow say this two people wan seat do meeting, but apart form that talk, you think say no be Dangote be the major problem of Nigeria food issues because from my own point of view dem no suppose da go meeting with man, if I go ask which kain discussion dem wan do with dat business manny that is serving his own interest.
But mak we caring chair seat think this matter well since dat time wey Obasanjo sell dis country giv Dangote na since then everything com tak change, price of consumable goods nor gree com down again
This matter just get as e be self

I understand the frustration for this post but Dangote dun really try for Nigeria and African as a whole oh, shey you know say dat man for fit carry him businesses and wealth commot Nigeria like most of the other business man dey do and our politicians wey dey steal from us to empower other countries. Dangote for fit dey like dem but him no gree leave Nigeria instead him dey invest him money here steadily. See as nobody gree reason build private refinery since but Dangote dun stand and run am. That man dey lose money steadily as him dey always drop for list for the richest man in the world due to the economy of Nigeria yet him no stop him investment here.

You know how many people Dangote dey give job so, the country bad na just the fuck up and Dangote get business to run so as economy dey worst him need balance am with increase of his product so him fit generate money pay him workers world wide. You no go expect billy gate to come Nigeria and him no go discuss with the richest man in Nigeria and Africa with the president. E no get anything wey dem wan discuss to spoil Nigeria. Na always for the betterment of the nation. If e get one man wey get Nigeria for heart na Dangote so no put blame on am, direct am to the government.