With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.
You don call am as little as 30k but remember say na our minimum wage for this country be this oo wey be say some states never still dey pay am.
Anyway, wetin I see for this bicycle matter be say na those wey dey village and rural areas this go fit make sense to. Me I no no whether Tinubu want begin pursue people go village like this oo

And again for those wey dey for town, urban locations wey be express, hmmmm me no go advise this bicycle transport thing oo because our road no even good like those wey dey use bicycle for abroad. See you see orthopaedic hospitals because casualties from accident go plenty oo. Make we just dey careful, make God dey bless him people make we still dey follow dey survive inside this unfortunate harsh economy.