This binance issue no suppose worry us too much, binance still dey operate for naija. The thing na just about wanting binance to identify with them. We sabi say our government na follow follow, so dem dey follow wetin dey happen for Canada, USA also. Na about regulation wey sec want to bring come because dem want to dey know about binance business for here. No cause for alarm for now.