My people how una see am?
Chale this your idea nor bad if to say we dey for country wey be say :
- bicycle get him own lane
- proper security dey to ensure say e go hard before person fit thief your bicycle
- distance between your office and your house nor far
*the risk wey dey for bicycle na raised to power 1000.
One of the ways wey bosses for offices fit help people durin this hard times na to reduce the working days and institute hybrid work. So unless say you dey work for factory and for some other places wey be say e dey very essential say you come work everyday, I nor see the reason why we go dey go work every day of the week during this time for work wey we fit still dey house dey do. This one na another solution for office people. Factory workers them fit try to dey join staff bus or encourage their oga dem make dem buy staff bus if dem nor get. I drop my own suggestion.