Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.
Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.
I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.
My people how una see am?
Omo I nor lie you personally once in a while e good make person still do exercise with bigmanity and na bicycle fit in apart from say fuel price don high now ... bicycle don dey on the high side because many people wan come dey buy this period so if you first get sharp bicycle before Omo ride am like say you come change game ohh ...me I get my own and I do use am steady
But deep down omo bicycle nor be game changer shaa ... Na second option...hahaha