Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bicycle fit be the game changer
by
Adbitco
on 03/07/2023, 10:24:04 UTC
My people how una see am?

Hehe the way the country be self now na something wey go make us reduce expenses we dey find now self at least e go help us wella onto say the fuel price now na casala for we country. If na to move within only the city e better pass to dey enter bolts but come to think of this what if rain fall wetin you go do to fast track your movements, knowing say with moto you go dey fast than using bicycle.

Well, make i just say anything wey get advantage also get disadvantages because you can't compare both since we are in the wet season and rain dey fall unannounced and anytime wey im like in dey fall. The only way i think say entering moto go even better pass na to dey go another state or another LGA wey far from your city e go worry pass.
Anyway, na good suggestion be that but e go only affects those wey no sabi ride bicycle.