Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.
If u sabi watin b comfort, u no go evn think bicycle as e dey sweet u 4 mouth like dis.
Yes country don jaguda, e don turn watin pple no understnd or xpect bt, 2 fall bck 2 bicycle 4 dis our time way we dey try meet up western world, way pple dey reason buy Tesla nd machines way dey use renewable energy sources, bicycle no go come in.
D least we fit do na true unionism ask govmnt 2 luk into d mata well. As e b now way petrol price b #511, mak dem try leave am lik dat. Mak dem generate watin dem fit generate nd fix our refineries.
I no dey see myself risk riding bike way go shine u 4 road if u fall nd d kind sweat u go sweat evn 4 short distance. Na bicycle u wan run go work. Dat na 2 baff wen u reach work o.