Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bicycle fit be the game changer
by
Black susano
on 03/07/2023, 23:30:57 UTC
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?



(OP) this post really get much sense but no still get sence,
Imagine place like ABJ all most all the areas fall for which other so you mean say! person go clamp bicycle like small pinkin come dey ride on top mak I tell u something u dey only talk about this because of poverty wen hold us ohhh
If not were person one go with bicycle. See look am form my own point of view how many speed I wan use speed before I go work and also with this type of bad roads e be like say body ever pain u before, I bet u if u com back form work you most take drugs first before you get ur self back for that day