Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: New KuCoin kyc policy!!!
by
Gozie51
on 04/07/2023, 13:14:40 UTC
KuCoin talk say then go make kyc mandatory for new members wey just dey create account with them, so if you be new member you go need complete your verification before you go fit dey use your account, no be like before wey you no need submit any documents before you go fit use KuCoin. Also old accounts wey register before 15 July go need complete their kyc also, if you no submit your documents, then plenty things go dey wey u no go fit do. So incase if we never complete our kyc and we get money for our KuCoin, make we do am now to avoid unnecessary story, and if you see say you no fit submit your document, then make we move our money commot for d exchange.


Wetin we go understand about this KYC be say na way wey dem don begin regulation so e no suppose to be new thing now, make everybody ready for am. This kucoin own now wey dem dey talk about new people na because dem just dey fresh so dem just say make dem kukuma catch dem young so that if you no want you go just carry your self comot. So KYC na for everybody whether new intake or those wey don begin with them.

On a normal level the thing suppose dey go phase by phase until all man go complete am or for those wey no want do am, if them time expire to provide those kyc requirements, dem fit just block dem or dem no go allow dem withdraw.