Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bicycle fit be the game changer
by
Odohu
on 04/07/2023, 14:41:03 UTC


My brother no look am only in the angle of poverty. Make you consider the health benefit too. Even for Oyibo country like Netherlands, Bicycle plenty wella and even people wey chop belle full dey use am with pride. E go even shock you  to know say every person inside the Netherlands get at least two bicycle according to this article: https://www.hollandcyclingroutes.com/

We no doubt say oyibo dey use bicycle take do their kind of shuttle movement but those places their government do road well wey dey give everyone ease of movement. If you want use bicycle there you dey sure say no tricycle or motor go hit you on to say every one get their lane but for naija e no be the same thing.. The challenge for this country full truck remain. Even some west African countries self organise pass naija, I no even talk of South and East Africa.

You just dey talk like my elder brother wey be your namesake... him sabi book like winch. Wetin sweet me for this your comment be say you agree say bicycle get good side and oyibo dey use am too. One thing I wan put inside this talk be say, if plenty people don dey use bicycle for naija you go see say awareness go start and na so e go take catch government attention to put am for consideration when constructing roads and other infrastructures.  Naija strong sha but wey go dey ok one day.