I just received this information for my gmail, and e dey KuCoin website also. I dey sure say e go dey useful to all of us wey dey dis board na why I say make I drop am here. KuCoin talk say then go make kyc mandatory for new members wey just dey create account with them, so if you be new member you go need complete your verification before you go fit dey use your account, no be like before wey you no need submit any documents before you go fit use KuCoin.
Dis one no shock me say this update dey come out just before the bull market wey be say investors go begin full the crypto market wey dey come ahead. E dey always surprised me when Kucoin no be decentralized exchange but an average player for the centralized exchanges industry yet e still dey run no KYC parole and SEC never come for them. Well I been know say na just a matter of time before dem go join others dey begin dey make am compulsory say make we all run our KYC verification. See eh e no bad when this centralized exchange dey request am because they're mandated to know their customers to avoid any mumu business wey men wan use their exchange dey run.
But for the sake of privacy, those KYC no make sense and that's why we get other options wey be say people fit dey use and they stay anonymous. I just dey pity kucoin exchange because some of their customers na people wey dey run away from all this KYC wahala so as kucoin before no been dey request am. Men begin dey use the exchange but now wey dem dun join others to request KYC it means they no get advantage again and it's better to use a well recognize exchange wey be say get plenty volume than now using kucoin when you go still need to verify your KYC. Kucoin dun fuck up although I no blame them.