Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: How difficult life would have been without Cryptocurrency awareness in Nigeria
by
CryptopreneurBrainboss
on 04/07/2023, 19:26:58 UTC
⭐ Merited by Igebotz (1)
I use to think about how difficult things would have been for us as a Nigerians if there was no Cryptocurrency, considering how difficult it is to get a well paid job, I wonder what would have become of us, but with the help of Cryptocurrency  things became  more easy with many ways of making money through crypto as such most people now prefer online than working for someone. But Most times I use to imagine the way this country is moving, thousands and millions of unemployed youth, to even make the matter worst government doesn't even care about the welfare of the citizens, they does what they feel is right undermining if citizens are okay by it or not, There are millions people graduating everyday but no job.

Your life before you started crypto and now which one is better? Let's share our experience.

Minus joke, money wey I dun lose for this industry plenty pass the money wey I dun make but why I no dey reason am na because na still this industry wey give me am which means If I wasn't in the industry I won't have made that money that I lost so I just dey take am like sacrifice wey I give the gods of crypto and believe say more go come for future. Now to you questions, Nigerians no dey take last, we for still survive. No be today wey job no dey the country yet man still dey survive so e no matter if cryrpo been dey or not me for still find way to make am (I never still make am but I know say e no far again). Before crypto come I dun dey learn forex and been get other plans to learn programming (coding). Crypto just dey easier na why I leave others to focus here.

Men dey use all this things I dun call their names use survive for the country so e no belike without crypto men no for fit chop but make I no lie, crypto money sweet and if you dun understand am you go chop well. When I dey talk about crypto money I no deg mean this small small change wey we dey get for this forum. I mean better block wey investing or trading fit give you. If you do your maths well and God favor you forget am na major block wey you go cashout from the market. We need to stop dey rely on the government. If na you wey get over 200 millions children, talk truth you go fit manage them. We need decentralized the politics for the country if we want the country to get head, each states take care of their problem and pay taxes to federal government.