Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bicycle fit be the game changer
by
CryptopreneurBrainboss
on 04/07/2023, 20:08:53 UTC
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Belike you no know the country wey you dey if bicycle begin dey get demand just watch as price go boost like fuel price. No be dis country wey person before fit dey buy corrola car for like 800k  or 1 million but as boarder close and bot and Uber begin popular na so corrola jump to lik 3.5 million before you fit get direct Belgium wey go dey alright for you to use without any complain dem. If bicycle become they way forward, the average Nigeria still no go fit afford am as people no go wan buy the old version na the latest ones people go wan dey buy and na so dem go use price wan kill us. This country na from pot to fire, e go hard before something good go happen for the economy of this country.

And this one no be we getting the right president solution because e come dey belike those guys no get say self because of the way the country dey. If tinubu know say him no go fit use our subsidy money do better things wey go better this country make him bring back the subsidy oh before people go die finish because e no easy again. I dey hear self say dey wan increase the fuel again go like 700naira per liter. If dat one happen e mean say 1k no far again and e no go easy for everyone because no matter your means of transportation, e go still reach you either when you wan buy fuel for your car or pay transport go work.