Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Signature campaign announcement 📢
by
Mr.right85
on 07/07/2023, 11:17:59 UTC
To learn dey sweet for body when you dey learn and earn at the same time. Na the reason why I say make I create this thread so we go dey update each other on signature campaign wey launch newly or the old ones wey get open slot as e dey happen for other local boards. I check the board but I no see such thread (if e dey already abeg call my attention so I go lock this one) na why I say make I create am.
E be lik 2 learn go hard u o, knowngunman.
Try dey read mak u dey understand nd mak u no feel say, persn no fit tell I somtin 4 here. If u feel say here na where u go enforce ur opinion nd no go get contrary view, I go see reason why ur name na knowngunman.

Imagine say we wan con dey paste bounty as u don carri sig matter lik dis, no b small spam u go see here o. D board go jst full anyhow wth watin don already dey,
Wetin you dey try yan guy? No be you go tell me wetin I go do abeg. I no sure say you read through the thread sef before making this your comment. Wetin bring bounty issue come here now? Did I say make dem post every bounty and signature campaign as separate thread in the board? You for dey chill read with concentration and ask question if you no understand. Difference dey between read to understand and read to comment. You just justify that statement now.
If u read u go seewhere i talk say mak u imagine say we dey update bounty lik u dey propose 4 signature. Abi u no kmw say both na campaigns or you feel say all bounty no get value abi dem no get bounty way dey pay in USDT or ETH cef.

Guy, try dey concentrate waka 4 forum, no b only service thread nd sig mak u 4 dey learn. Thins way dey here pass lik dat.

So bcus Charles-Tim see am as gud idea, e mean say anode persn no ft get contrary view.

I stil dey rubbish am. Dus thread no go anywhere, pack am nd throw for waste bin. No point duplicating service board here.