Golden feathers of the month(Merit award winners)
1. Wiwo [26]
2. Kelward [22]
3. CryptoHeadlineNews [18]
Omo.. Na the way I carry reach among these 3 names listed above nah I no understand oh, because I never expected it my gee. But shah, I go really like to thank you so much @ Sir Igebotz, because you dey really try, I no go lie, and on that note, I hereby call you the G.O.A.T of this our local board, because you be indeed sure plug wey dey deliver.
Secondly, I can see you added a new feature on the overview of this month (i.e the statistics of the highest merit receiver & senders within our local board) and I go talk say eh make sense.
Ma gee your hard work nai you don reap so, its nice to see members like you and everyone making our local board a really super place because our local board nai go befit our reputation for the forum here as Nigerians and so far we dey do well thanks to active members wey dey really try their best to make these achievements come true.
Naija boys we no dey play when it comes to working hard and we dey show am for here too so I thank everyone for their big efforts and make we just keep am up.