Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigerian crypto tax move is ‘premature’ — Local stakeholders
by
Coyster
on 11/07/2023, 22:24:54 UTC
⭐ Merited by Charles-Tim (1)
Our problem for this country just circle round the former CBN governor, dat guy was a cancer in our economy.
Godwin Emefiele suppose be one of the worst CBN governors wey we don get for our history, the guy no just try at all, any policy wey him bring na regressive one, e no get any policy wey CBN make under Governor Emefiele wey dey progressive, the guy mess our economy up no be small, you no see say Nigerians dey happy as DSS carry the man, the man matter tire everybody.
Nigeria regulators just need something to be done, especially about making those exchanges to register in Nigeria and be taxed.
Dem no really understand wetin dem dey do and they no wan seek expert advice, wetin i find out be say our regulators no realy understand crypto and the benefit wey the country fit gain from am.