Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: You Can now convert dollar to Naira in your GTB Internet banking platform
by
Youngkhngdiddy
on 12/07/2023, 08:23:35 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (2)

E be like say this one go spoil market for aboki them. Well, me see am as good thing as e go save people from fake dollar and also help in price control. How una see am?
Many people go see this one as welcome development, while some others no go take I'm likely because eh go be like big competition to their business especially those aboki peope wey dey change money, OP like you done talk, eh get better possibility to spoil business for them because a lot of people wey dey leave far from them due to distance no go wan drive that far or pay money to go meet aboki  when them go fit easily go open account with Gtbank then change their dollar from the comfort of their home. And this new development from Gtb go attract new customers to their bank.
 Well the only thing wey I feel say fit hinder this development na the rate, and if the rate a which them they buy they fair or almost equall to the price of that of the aboki people them then na big gbas gbos to their business because i no see reason why I go dey waste time they journey far to go meet aboki to exchange dollar when I fit do I'm from the comfort of my house and all eh go just cost me na an account  with Gtbank, a good device and data connection.