My country people. E get wetin I dey observe for we country wey I wan make una follow me put mouth. I notice say our young bobo them no dey too marry early again. My papa tell me say for their time, before you reach 25, you done already marry or about to. But today, 30 self never put marriage as priority. Plenty good reasons dey sha o but some their reasons no reason enough to be single at certain age.
On the contrary, I no dey observe d same tin way u dey observ. Watin Me I dey see b say, youths now dey marry quick. Persn cef way jst leave en papa house nd e hit any better money frm any means, na marriage go b d nxt tin on en mind. Dat no mean say, e no go stil dey carri olosho bt, 3 understnd watin olosho dey tak frm am nd him kwa need persn way go attend 2 en needs lik 2 dey wash cloth, prepare food, clean house nd d rest way concern wife 4 marriage following our African tradition. Especially wen pikin nevr join b4 e go start 2 dey need house help.
On top of dat, d idea say mak pikin follow papa nd mama dey grow dey very strong now dan in d 90s.
Mayb na ur area u dey observe dis one u dey talk ndi understnd say, man dey try avoid load way e nevr dey sure say e ft carry bt on top of dat one, pple way stil dey risk am dey kwa.