Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: I want to place advert for my customers to fit pay me with bitcoin.
by
Merit.s
on 12/07/2023, 14:57:10 UTC
OP, nobody get right for Nigeria to tell you say make you no accept or use bitcoin because na we dey carter for ourselves. Government abandon their work wey be to take of citizens,come dey thief our money. Bitcoin in business will add more advantage to your sales because you accept varieties of currency. My only advise as Brainboss talk put am on the low,anything to put am for social media say you dey accept bitcoin no make sense. Tell only your customers wey you fit contact. You no go regret am,if you take this bold step.