For my area now bicycle full street like this, atleast the bicycle go help else movements and save costs till when the fuel price go come down. Even me wey dey here sef if I get small money, I dey think of to buy one small bicycle too wey I go dey use till when the fuel price go come down, I can't come and kill myself....
Who dey talk of say when fuel price go drop abi come down. This one no possible again because I remember even from president Goodluck Jonathan time when him first say him remove fuel subsidy and price rich 145 naira and him readjust back to 96 naira or so and from then Buhari enter carry price go 150 naira and since then, we know how the price don fly reach. My broda no think am oo, I never hear say fuel price go come down. Abi you dey talk of deregulation? Hmmm, deregulation dey only bring price down when things dey in place like refinery etc but government refinery is not working so make you zero your mind out of that .