We've heard from the news, the plans federal government has towards the poor, they say is to cushion the effect of fuel subsidy, which is giving the poor 8k per month for the next six months to 12 million people.
Now here is the interesting part of the whole thing.
No mind them, dem dun dey find new ways to carry pocket money wey was meant for poor masses. Why we no get sense for this country, our government only like to dey give palliative so we go dey mumu for dem dey vote dem into office so dem go continue to dey give us chicken change from the millions dem dey thief. So you go give millions to politicians for allowance and salary but na 8k you wan give family to use hold body because of fuel subsidy. Tinubu dun dey disappoint me, I no expect him administration to dey follow bubu steps. Why dem no use this money put together carry do something wey we go see know say our government dey work and that thing fit bring employment for us so we go dey see food chop everyday and no be this handout wey no go even do to feed us for 1 day.
You no know the poor masses, na their people dem na, na people wey go pocket the money as dem dey use am compensate them for helping in giving the current administration power. How dem go use track say the money dey go the right home if for real dem wan run this thing from their good hearts. Make we just believe say true true dem wan dey give the poor masses 8k, how we go fit comfirm say dem really give them or na just cover up for them to steal billions and when we question dem, dey go talk say na wetin dem use they give the poor masses 8k. We need to dey stop dey believe this guys, I bet na highest one month dem run am and pocket the rest.