This one na better news for people wey dey use Binance, i know say Binance get their drawbacks wey mostly concern privacy, but person wey don already register for the platform no suppose bother about that one because them no get privacy again, so i no see any wahala if a Binance customer use the lightning network on the exchange.
E get plenty people wey been dey criticize Binance say dem never add Bitcoin lighning network as part of the services wey dem dey offer, so e good as dem add am, and i believe say now wey Binance don add am, many exchanges go also try add am in the future.