<snip>
I neva hear cryptobundle exchange before, na de first time wey I dey hear about dis kind of exchange. Even de big CEX I no trust dem, e come dey surprise me as people dey use dis kind of exchange wey no get any reputation at all. A scammer fit just dey for him hauz design small website wey look like exchange with de intention to scam unsuspecting traders or users, run am small and shot down operations after dem don run am small. Well e good as you take bring dis news come here, as deir name dey sound cryptobundle, any person wey get funds deir, make dem run go comot am before dem go bundle am run away.