Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Everything wey you wan know about ES Volcano Bond but dey fear to ask
by
Hatchy
on 22/07/2023, 06:03:51 UTC
Quote
d city no go put any traditional tax like d income tax, property tax, capital gain tax or even labor tax for e people dem. Instead, dem go only get 10% sales tax wey dem dey put when person buy something and na dis wan dem go take dey fund the country matter.

After I read dis threads finish, one major tin wey I come dey reason na e be say if them commot these taxes come put am for food or products wen Dem dey buy, dat wan come mean say tins go cost wella for dat side.
But Dem people no go too reason am because, Dem no go dey cut commot from their salaries, You fit get as many properties as you want am, wether na hux or car and Since Dem go commot capital gain tax, dat wan mean say more of dem big men go just dey gain more and more wealth.
As I reason all these tins I come look our country, if dis kind tin go ever dey possible wey Dem go commot all d tax wey bokku come put for food or goods, dat wan mean say we no go just dey chop again may be 1 bag of rice go just be 100k
And dis wan go benefit our politicians Wella as na more opportunities for dem to thief.